Monday, November 30, 2015
SAPELE DELTA STATE MUST BETTER...
SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. 30/11/2015. THE ENTIRE SAPELE PRAY FOR THE SOUL OF THE GIRL (Late Miss Rejoice Aghogho Igbi) WEN DAT EVIL BOY "SILAS" KILL SAY HIM USE MAKE MONEY! This na Sapele wey be the most peaceful place for Delta State. A town devoid of Ethnicity crisis and other crimes. "Tears" During the late 90's, people from Warri dey relocate to Sapele just for residents becos dem find the place very accommodating. Today Sapele don change,and DAT useless change nor go last! Sapele dey good in times of our forefathers. But for our generation, the reverse is the case. What a shame. We just dey record one form of death and another. (Sad) Dis morning, I nor wan talk much to corrupt the mind of people becos, na ocean of tears dey commot from my eyes. All of a sudden everybody for Sapele wan rich. Drive Big Cars. Go Club with Voltage. Build and Stay big House. Etc Dem talk say money na the fruit of all evil and na just d simple truth be that. Money, is the fruit of all evil indeed! Silas say na somebody call am to provide Human Head from Ghana. So that him go become Influential and get so much money. Now make we commot from this Silas issue becos na something dey bring something out. Na for Sapele, we go see one of us, either wen nor go school or get work, go just travel for like three weeks to few months, and when e dey come back, na with big Motor. For this Sapele here, both insane and normal people go begin celebrate the person. Nobody go boldly ask where and when he make the money wey he dey throway for air. The funniest thing be say, many Parents go say, God don answer deir prayers. Papa and Mama don dey work and dey do business for Sapele, for the past 10 to 20years and dem still dey rentage. Pikin go just come with Millions of Naira. None of unu go fit carry the pikin Sidon, ask am how e take get e money? Dem go use blood money build house for papa, papa and mama go park enter go stay without question. Dis act must stop and Sapele name must be redeemed back to that Peaceful town wen we all dey enjoy and dey proud of. One thing wen we go know be say, if you kill today to make money, to sustain that money, more blood go definitely dey required tomorrow. So the killing go continue. Make I turn face our Government officials! Wetin be the reason wen make us vote and get unu as leaders? One major reason na to get leaders to Govern us with Policies wen go make the place grow from its normal state to the next level. If dem leave me, na the Government officials and Leaders wen we get nai me go face for this matter becos dem fold hands dey allow all dis evil acts dey continue. Today I dey call on the Leaders of Sapele to keep simplicity outside and face the fact of the day. E don reach the time, dem go dey carry some of us, wen dey spend money anyhow for this Sapele dey Sidon. Most especially Boys with Big Cars and Houses without any reasonable jobs to explain to unu the leaders how e take get him money. The fallen Heros of Sapele go don dey disappointed for their various graves, becos the good name wen dey hand over give us, we don dey abuse am before the International world. Today I dey use dis update dey call on our Sapele sons and daughters; near and far to join hands and eradicate dis menace for us. I dey call on the security agents to get to the root of this issue. To locate the caller from Ghana wen request for the Human head. Poor girl, just became a victim of circumstance! I think about her parents. I think about her mama when she get her belle. I think about her family members. I think about her friends. I think.... "Tears" Her dreams. Her thoughts. Her goals. And I think about God. Why this? Why?... "Tears" All the laws nor go fit pay for the blood of any human being. Justice cannot bring back the joy she give her family. But dear Lord, let her killer never go unpunished. I hardly lay curse on anyone cos everybody na my own. But this life wey Silas take, God go ask of am from e hand. My people, why the rush to make money? If na your destiny to be rich, even if na trek and carry waka you dey trek and waka for the town, when your time for God's agenda reach, you go trek into your millions. Youths! Sapele youths! Where unu conscience? If government bad nor mean say we go kill ourselves to make am. Make we search our mind and turn back to God. The cars, the buildings and the clubbing, all na vanity,we go die leave them one day. Just face your hustle. Everyday for the hustle, but one day for the hustler. One day, you go break into your billions. So calm down. Any fast way dey always get deep pit. To the young girl, all the tears from our eyes nor go fit sail you back to us. Not now. May God give your family the fortitude to bear this loss. Amen. Sapele mourns your death. May your soul find peace in the bosom of God. Amen. Report don reach us say,dem don transport the killer to Asaba for more interrogations and questioning. I know say the Law must condemn Silas to hanging,but it interest me to know the "Caller" becos as dis one fail,e go still try other means. So them must get am down. Let the IG be informed about this act,to pen the source of the human head request down,as fast as possible. We for Sapele Tafia Studio, light a candle for you,with our up down Blacks to wish you safe trip to Heaven. "It is better to make Heaven at a young age,than stay till old age and make Hell". Rest in peace till we meet to part no more. Amen. "Tears" Join us as we pray make God repose her soul by typing Rest in Peace. "Tears" May we nor experience such again. Amen.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment